Dear Rochas
Dear Rochas.
Na man you be.
You give EFCC staff work.
Tell them say if them must catch you.
Them must do the work.
Them break so tey dem tire.
Them go manage break ceilings enter.
Them sweat shaaaaaa.
Na man you be.
The only small wahala or shame be say.
You come dey fear EFCC.
E be like say you don commit.
Na wa sef.
These APC no fit collect the N100m as bribe?
You buy ticket na.
100mili.
E be like say them know say you get pass N100bili.
Hmmm.
If to say you know.
You for just buy 30 forms.
Maybe the money for reach commot face.
Dem fall Baba hand shaaa.
Baba go down low.
Baba no fit even Buga.
I swear. Even if Kizz Daniel dey that house sing Buga featuring Wizkid and Burna Boy with Davido hook and Flavour Chant. Baba no go Buga anything.
Baba just prefer the lo lo lo lo part.
Because baba dey ground low low low.
Chai. The EFCC guys dey outside dey do One Legge.
As one legge no work.
Them Sungba enter.
Once them enter dem begin Zazooo.
E get one dude wey try to challenge the EFCC men after them don package Baba for their Uber things.
That dude na the hero.
The guy chop floggings.
He still hold him ground.
Whereas none of Baba Rochas children come outside o.
Rochas shaaaaa.
Why he no just Buga go outside knowing fully well say him family dey inside the house. At least be the man.
So mistake bullet no go hit any of the family members.
But wetin exactly EFCC want?
Wetin Rochas do them?
Dem say e don tey wey dem dey call Baba.
Say Baba Rochas no gree come defend him case for court.
Dem say Baba thief N2.9b.
Dem say make we ask Honourable Justice Inyang Ekwo of the Federal High Court, Abuja about the many attempts to arraign Senator Okorocha twice since January 24, 2022.
Dem say Baba just dey form hide and seek for dem. The matter tire dem.
Them say the justice on top the matter sef tire.
She tire so tey she say this May 30th. Go be the last time she go adjourned the matter to. After Baba Rochas no show for March 28th.
Anyhow shaaa.
If dem ask Baba why e no show for March 28th. Make him tell the Judge say e be ASUU member in the spirit. Because I remember say na that day ASUU reopen this their latest strike.
But e fit still tell them say Nigeria vs Ghana World Cup qualifier na a day after that said March 28th. So e reason am say if he come court and the matter come go the kind way he no expect. He fit not get the chance to watch the game.
Ghana play Nigeria for that same Abuja for 29. Maybe if to say Nigeria even win that match sef. Judge and EFCC belle for too sweet to remember say one case suppose happen that Monday.
S/Eagles una see una selves?
Anyway.
Baba just go answer dem sha.
This Bubu administration.
Anything can happen.
You fit reach their now make them ask you say, “why you no raise statue for Bubu?”
You eff up shaaaa.
You spend that kind money do 8 Africa Presido. You no do Bubu.
No be you find trouble?
N520 million na the rumour wey we first hear.
Say you take do the statue.
But later sha.
Your people say na April Fool.
Say na just between N400k and N500k each for the statues.
Chai…
If to say Nigeria chop that bobo.
Maybe EFCC for no fit even see any fraud.
But you for try do Bubu own.
Bubu own for no reach N400k. Bubu just slim and tall. N100k for do that one and you for say na N1b. Now na only N1.9b you for dey find now.
But wait o.
You raise Statue for Buhari na.
I remember.
Chai.
You don forget say Baba talk say,
“I belong to nobody” ?
You go do too much.
Na to find the N2.9b
Tell them say na April fool.
Sell one house play say Liverpool to win.
I just hope say you no use any of these money play 3odds.
One day we go say these Governors fit dey use our billions take dey play 3odds shaaa.
These bett!ng companies dey hammer shaaaa.
Meanwhile 17 count charge on top N2.9b.
This money small shaaa.
I hope say no be game be these things shaaaa.
Your Buga Omo spotter
Ediale
#ForTheCulture
PS: Dino Melaye that time no follow EFCC drag too much. Baba just say he go stay for cargo bed (back of a pickup truck). Once dem reach the junction wey Dino know well well. Oga jump enter Bush. No drama politicians never show to avoid jail term. Some dey faint for court. Just wait for 30th May. If you no see Rochas with bandage for neck or if Baba no faint. Just wait.